IFE

Ife,
You sleep
You wake
You con dey rake
You grab my days
Like say na you get am
Like play like play
I don dey mad

Ife
WETIN dey
I no chop
Una no come
Una put for head
I put for chest
Kponkpi!
I don dey tell una
This land don dey ploughed
Omo believe am
Feel am.

Ife
Gamaliel
I nor dey look mirror again
Na you be my mirror
I nor dey play Bach for sunday
Akpors self don commot
Na you be the mirror wey I dey look
As e be so
Na you be the song wey I wan sing
Choi!
Make me self go go
I go go sleep


As e be like say na my sleep you take do house.

Comments

Popular posts from this blog

Buhari, Osinbanjo Take this oath

not my plan

please let me not grow